Thursday, July 10, 2014

E Go Better.

*I will attempt to write a full post in pidgin, also known as broken English/vernacular*

Na work you dey find? Abi you get work but e be like say dem send your boss for your matter?

You say no be work mata? Ok. How market? Business just dey dull abi money no dey your account at all?

What of the spinsters and bachelors? Na wife you dey find so tey you don give up abi an husband you dey pray for day after day? Hmm...what of you when don marry but never born? Dem people don dey ask you say "where is ya God?".

No be dat one dey do you? Okay, what of the one wey just feel like say things dey work against am, e be like say nothing nothing dey work for your end?

Whether I talk the one when dey do you, or I no talk am, I wan tell you say E GO BETTER!! Lai, Lai, no be poor man prayer. God dey, He dey see everything when dey worry you and I wan remind you as oyinbo dey talk am, say "there is light at the end of the tunnel".

No give up, carry all your wahala then give am to God. Ask make He help you. Walahi, this problem when you dey face so get expiry date oooh!

My brother, my sister, e go better!

Love,

That Girl.


1 comment: